Rev. Fr. Daniel Okanatotor Oghenerukevwe has married Ms. Dora Chichah as he dumped being a reverend father in Streams of Joy Church for Dallas.
Who remember when I tell una say one Rev Fr. don dodge go do marriage? The matter don finally cast oh😛😛
Una go remember say we tell una here sometime ago say one Rev. Fr get steady wife wey him dey doke codedly for this warri but plenty of una wey be gullible people begin insvlt us and even report our page.
Na Rev. Fr. Daniel Okanatotor Oghenerukevwe Dodge go do wedding 💍 with his long time girlfriend wey her name na Ms. Dora Chichah for Streams of Joy Church for Dallas, USA, on 29 December 2024.
According to our undercover reporter, Rev. Fr Daniel don dey date the bae on code since and both of them dey give each other better hot obenitatata 🔥 until the babe con begin mount pressure on Rev Fr to officially marry her or she go move ahead. When Rev Fr reason the way the babe dey give am sweet obenitatata, obenikoroja and ohangikoroja with a touch of collapse doggy style naim Rev. Fr say kpatakpata na garment Catholic Church go collect from am naim he go run the marriage for America.
As we dey talk now Bishop of Warri Diocese, Rt. Rev, Anthony Ewherido don suspend Rev.fr and the Rev Fr don tell them say make them go look bush oh say him don already sack himself 😛
Man wey God call, woman use kpekus call am back 😛
If Rev Fr fit abandon his calling because of kpekus, who am I not to abandon blogging because of kpekus 🤣
0 Comments